Ethiopia legend Haile Gebrselassie go follow Prime Minister Abiy Ahmed join di war for di battle front

Wia dis foto come from, Getty Images

Ethiopian Olympic legend Haile Gebrselassie don announce plans to go di battle front, just one day afta Prime Minister Abiy Ahmed announce say e go join di fight against rebel forces from di northern region of Tigray.

Distance runner Feyisa Lilesa, wey become famous for im protest dor di 2016 Rio Olympics for crossing im wrists over im head - a sign wey show anger against how di goment dey treat di Oromo pipo, go also join di war front.

Several high-profile Ethiopians don make similar announcements as di fight don enta an oda level and rebels say dem dey march towards di capital Addis Ababa.

Dis wan dey come as fotos show online of Mr Abiy heading dey go out to war as im dress in military uniform inside convoy wey dey surrounded by special forces.

E no clear if di PM don already join di fighting as BBC no fit independently verify di fotos.

Wia dis foto come from, ADRIAN DENNIS

Wetin we call dis foto, Feyisa Lilesa cross di finish line of di Men Marathon athletics event during di Rio 2016 Olympic Games for di Sambodromo for Rio de Janeiro on August 21, 2016. - Lilesa bin cross im arms above im head as e finish di race as protest against di Ethiopian goment crackdown on political criticism

But di Ethiopia prime minister bin say im go now lead im troops "from di battle front" as di year-long conflict move closer to di capital, Addis Ababa.

"Starting tomorrow, I go mobilise to di front to lead di defence forces," Oga Abiy, tok for one statement wey im post on Twitter late on Monday.

"Those wey wan be among di Ethiopian children, wey history go hail dem, rise up for your kontri today. Make we meet for di front," im add..

Dis tok dey come afta di ruling Prosperity Party executive committee meet on Monday to discuss di war.

Di defence minister tell local tori pipo afta di meeting say security forces go start on a "different action" ontop di katakata.

Since last November, di goment and rebel Tigray People Liberation Front (TPLF)'s forces don dey fight war wey start for Tigray and e don spread enta neighbouring Amhara and Afar regions.

Wia dis foto come from, EPA

Di TPLF don form one alliance wit oda insurgent groups wey include Oromo Liberation Army (OLA) as di fight-fight don dey reach di capital.

Special envoys from di African Union plus di US don dey try to ask dem to stop di fight in recent days but notin don happun so far.

Settlement toks wey African Union envoy, Olusegun Obasanjo dey lead, don lead to little progress.

Di one year-long conflict don lead to humanitarian crisis, thousands of pipo don die, millions dey displaced and hundreds of thousands dey face famine.

Several kontries including US, France and Turkey don ask dia nationals to leave di kontri immediately.

'No be di first time'

If Abiy Ahmed enta war front to fight di Tigray crisis, im no go be di first African leader to do am.

Late Chad President Idriss Deby bin lead di kontri army to fight wit rebel forces wey launch attack on di capital N'Djamena.

President Idriss Deby later die for April 2021 afta im sustain injury wen im dey fight for di frontline.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ethipia goment block aid say e fit get weapons

Wetin dey cause di Ethiopia and Tigray war?

Struggle for power, election and push for political reform na part of wetin cause di crisis.

Di UN want humanitarian intervention afta two weeks of conflict between Ethiopia military and forces wey dey back di leadership for di Tigray region.

Aid agencies dey call for immediate ceasefire for di main time inside northern Ethiopia to allow aid to reach civilians wey dey affected by fighting.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Oga Abiy don call TPLF and OLA terrorists and refuse to tok with dem

Why di katakata - Ethiopia Tigray crisis don worse?

Di root of di crisis start from Ethiopia system of goment.

Since 1994, Ethiopia don dey operate federal system wey be say different ethnic groups dey run tins for 10 regions.

One powerful party for Tigray wey dem dey call Tigray People's Liberation Front (TPLF) bin influence di setting up of dis system of goment.

Na dem lead one four-party coalition wey govern Ethiopia from 1991 wen dem pursue military regime from power.

Under dat coalition, Ethiopia bin dey prosper well-well but pipo bin dey worry about human rights and di level of democracy.

Small time, di concern and tok-tok turn to protest wey lead to goment reshuffle wey make oga Abiy become prime minister.

Abiy bin comot main Tigray goment leaders wey dem accuse of corruption. Dis move bin cause critics for Tigray to begin hala because dem feel say Abiy wan centralise power and dabaru Ethiopia federal system.

Di quarrel bin reach highest for September wen Tigray bone di goment to do dia own regional election. Central goment say e dey illegal.

Tins worse more for October wen di central goment suspend funding come cut ties wit Tigray. Tigray say dis one na war goment don declare.

Tension bin increase. Abiy come accuse Tigray forces say dem attack army base to tiff weapons.

"Di federal goment therefore dey pressed to use military confrontation," Abiy tok.

Since wen di fight start for November 4, thousands of civilians don dey displaced wit reports of civilian massacre.